BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Key events wey don happun since kidnap of schoolchildren for Oyo and Borno states
Di kidnap of plenty pupils and teachers from schools for Oriire Local Government Area of Oyo State south-west Nigeria and for three schools for Borno state north-east Nigeria on 15 May, don spark widespread outrage across di kontri.
Court sentence four suspects of Owo church massacre to death
Di Department of State Services (DSS) wey dey prosecute di suspects don ask di court to give dem di maximum punishment if dem dey guilty.
Unknown gunmen kidnap younger sister of ex-Nigeria minister of power Adelabu wit twins for Oyo
Oyo State Police command confam di incident on 3 June 2026, say dia men don visit di scene of di incident wia di kidnap happun.
'Expecting 84-year-old Adeboye to lead protests no make any sense' - Mike Bamiloye weigh on calls for RCCG leader to lead protest
To lend im voice to di trending video, di Christian filmmaker on im official Instagram account on Wednesday, knock pipo and bloggers wey dey drag and give false analysis on di cleric position.
Wetin we know about di California hostage situation inside bank wia pipo dey trapped
Tori comot on Tuesday, 2 June say one man hold plenti pipo hostage inside Chase Bank building wey dey for Chester Avenue and 17th Street, say di hostage taker carry bomb.
US go close down 30 embassies across African cities
US don annouce say dem go cut down 30 US embassies and consulates wey dey process visa application to Africans and leave 20 in di coming week
Rivers of drama as reinstated APC faction sack govnorship candidate wey Wike dey suppport - wetin go happun next?
Several oda candidates wey align wit di minister also emerge as APC flagbearers for di National Assembly and State Assembly elections.
Wat next afta political parties name dia presidential candidates?
Although political parties don announce dia candidates, mata still full ground sake of internal party wahala. So wetin go hapun next?
Grammy-winning Nigerian director explore role wey im grandpapa play for Biafran War
Filmmaker Meji Alabi direct landmark BBC Africa Eye documentary about Nigeria civil war.
Special Tori
Who fit win Golden Boot for 2026 Fifa World Cup
We chook eye for di common qualities wey World Cup Golden Boot winners fit get and how dem fit be di leading candidates for 2026
Sokoto hospital wia women dey give birth ontop mats
Badawa Primary Healthcare Centre, wey residents say na important facility for di community, don dey neglected afta one strong windstorm damage parts of di building almost ten years ago.
Nigerian teachers protest abduction of schoolchildren and teachers as victims still dey captivity for ova two weeks
Residents, labour activists and civil society organisations for di three states enta di streets to demand for di release of di victims and also dey ask diauthorities to strengthen efforts to address di worsening security situation for Nigeria.
Two pipo die for di Kenya protests against US Ebola quarantine centre plan
Di US plan don make di public dey vex and e don lead to demonstrations near di site of di proposed treatment facility.
Why Ghana authorities suspend fresh registration of citizens for evacuation from South Africa, warn against non-essential travel
Ghana warn citizens against non-essential travel to South Africa as xenophobic attacks increase
Rivers community Ofiomina-ama Alakiri wia fire dey burn on top water ova two years
Ofiomina-ama Alakiri community dey call for di Nigerian govment to stop di fire wey dey burn on top water and pollute di environment.
'Anytin fit happun to me now' - Gay pesin cry out afta Ghana parliament pass fresh anti-LGBTQ bill
LGBTQ pipo and advocates no want make Ghana president sign di new anti-gay bill wey parliament pass on 29 May 2026 sake of say e go make pipo live in danger of arrest and prison terms.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































